Pages

Friday 2 September 2016

WHY I ATTACK OLAMIDE – DON JAZZY DON FINALLY YARN.


Mavins boss, Don Jazzy don finally open up on the Gbege wey been happen with him and YBNL boss, OLAMIDE for the Headies early this year.
Don Jazzy say him react out of anger, as he dey very emotional about he kids. “I don learn lesson about anger, I no dey really vex like that. For dat particular point, I dey angry and emotional about my kids. You get understand say no greater love than the love of a father for him children,”.

“I think na the way people go know the amount of love I get for anybody wey dey work for
me. Especially those three. I guess I dey weak, I dey upset, speak out of tongue. I dey sorry to my fans wey dey  expect better from me.”  On how dey resolve the issue, Don Jazzy yarn say “Dat na the beauty about adults, two seconds after I don yarn all I yarn, I just regret my actions. I realize say Olamide sef do well with maturity, so we just get along. We no want the matta to escalate.”


NA so real matured mind dey relate, yarn ur mind and end the beef. 



No comments: