Pages

Monday, 15 May 2017

Tottenham wipe Man U 2-1 to spoil dem top four dream.


No be small match yesterday as Tottenham wipe man u 2-1 for dem home to spoil man u top four finish for the table.
First goal enter for first half by wanyama, for second half, Harry Kane con cane dem with the second goal before Wayne Rooney manage get one consolation goal for man u to end the game 2-1. The victory inside white hart lane make sense for Tottenham as e be say nanthe last match wey dem go play for insidp white hart lane be DAT for now becos dem get plans to renovated the stadium. For now, Tottenham go dey play dem matches inside the Wembley stadium.
Jose Mourinho dey hopeful for UEFA Champions League qualification if den fit beat Ajax for the final of the UEFA Europa league to give dem automatic qualification. He say for now, the top four dream don close, na to focus on the final be him goal.

No comments: