Pages

Monday 10 July 2017

BREAKING NEWS: Mc ONETOUCH yarn say: SAY NO TO JUNGLE JUSTICE.


The rate wey Jungle Justice take dey happen for Naija don pass be careful. The Aluu 4 matta still dey fresh for my mind, now na the recent one wey happen for Ikorodu to Mc Tink 2ce, onto the BADOO matter for younder.
Just because u suspect person to be criminal no mean say the person na criminal, nobodi get any right to lynch and pooff person anyhow, becos we dey country wey get law and order. Some pipu go say Police no dey try, but no be your duty to pooff anybodi wey be SUSPECT.
For pipu wey dey do Jungle Justice, abeg, wetin be the gain? After the Jungle Justice, the matta change or end? How u go feel if na u pipu gather dey beat like dat, when u know say u dey innocent? Abi, na how u go feel if na your family member or friend dey pooff unto Jungle Justice?
Abeg my pipu, e do, if una catch real thief or suspect, make una sharperly report am to police. No be by Jungle Justice. Na only the Police get right to handle the case, make we stop to dey take laws into our hands.
Many innocent pipu don pooff troway onto Jungle Justice. Abeg, if u see where Jungle Justice dey happen, no join dem, just carry your phone call police sharperly.
The death of Tink 2ce touch my heart wella after I see some bad video on the lynching and yet pipu gather dey halla 'kill am' even after dem don pooff am and him friends, burn dem alive and con still dey use cutlass dey butcher dem bodi. Why? I ask again Why? Who fit create just one Finger? Why Jungle Justice..
Abeg my pipu, make we use our head well, na 2017 we dey now, no be 1991, things don change, civilization don dey, make we dey live like pipu wey dey Law abiding.
Even say I no know mc Tink 2ce, the way dem take pooff and and end him career plus hopes wey the family get for am too bad.
My pipu, SAY NO TO JUNGLE JUSTICE... Na who Jungle Justice EPP?

Rest in Peace: Paul Chinedu aka Mc Tink 2ce

This na special message from Mc ONETOUCH and Team Ogbongeyarn.
Stay Blessed.... Stay safe.
God bless

Abeg share.

No comments: