Pages

Monday, 17 July 2017

GIST: Ibadan on Fire, as one market Burn and destroy goods worth millions.


One fire burst for one shopping complex wey dey for Agbokojo road, Ogunpa, Ibadan for Oyo State. Reports dey say the fire start for early morning around 2.00am and na from one storey building electric spark wey cause the fire so.

The building wey dey affected na shops, offices and warehouses with full stock of agricultural produce, chemicals, sprayers, provisions, building materials, mobile phones accessories, shoe materials, hair extensions (weave-ons) and store of one plywood supplier for the ground floor of the complex.
According to one source wey be night security guards and some neighbours wey dey around the area notice the heavy smoke from the roof of the shops, and dey try off am but when dey see say the fire pass dem, dem sharperly call the Fire Service station for Molete, Ibadan. Help no quick show, so goods wey worth millions just burn troway.
Representatives of the state government, Secretary to the Oyo State Government and the Special Adviser to Governor Abiola Ajimobi for security matters, Olalekan Alli and Segun Bolarinwa, don visit the place to see the level of destruction first hand.

No comments: