Pages

Monday, 24 July 2017

NEWS: Na 16 pipu Roast for the accident wey happen along Ife-Ibadan Expressway. see foto


Na sixteen pipu fire roast for the accident wey happen for Ife-Ibadan express road as one 18 seater bus and one fuel tanker get accident on Sunday.

Gist dey say the passenger Totoya Hiase bus wey carry beta speed been dey go Ife from Ondo State, but lost control before e jam one fuel tanker. Three other pipu get bad woundjor and dem don dey receive medical attention. The bus plate number na (LAGOS) MUS 702 XH, and na so e catch fire for the spot wey the accident for happen, passengers dey trapped inside the bus, dem try escape, but the fire roast dem at once.

Witnesses for the scene of the crash, count thirteen bodies of the victims, plus three children, as dem dey ground of one filling station, the Energy Petrol Station, apart from three already wey the medical team from the Seventh Day Adventist rush go for treatment.
Sympathizers been try to assist the victims before the men Fire Service show.
See more foto.


No comments: