Happy Birthday to the best Pastor I don ever meet personally, The Pastor of vision and mission. The best Pastor, Husband and Father.
Pastor Emenike Kalu na the Pastor of Christ Embassy, IGB Nation, Igbogbo, Ikorodu, Lagos. Plenty birthday wishes don fall on am as the full members of Christ Embassy dey happy and jolificate today. Na Pastor Emenike Kalu, inspire, Motivate, Guild and Advice me to dey do all wetin I dey do today. Pastor Emenike Kalu, give me the opportunity to host my first ever stand-up Comedy event wey I title 'LAFF ON SUNDAY', he don encourage me to do 2 editions so far, Na Pastor Emenike dey always encourage me to always do more work on dis blog (Ogbongeyarn). Many words dey to yarn about Pastor Emenike Kalu, but I dey short of words. Pastor, I no go ever forget all your words for.my life.
I know say God anointing for your life go everly dey increase from Glory to Glory becos of the lives wey u don touch positively.
Mc ONETOUCH and the full Team Ogbongeyarn dey wish you BIG HAPPY BIRTHDAY SIR. GOD BLESS YOU FOREVER.
1 comment:
Na so!
Pastor Emenikeis a man of Excellence,and the perfection of God's glory.
He is a teacher,a mentor, and man of God.
Pastor I Celebrate you this day.
To your increase there shall be no end.
For the Gospel of the kingdom of christ will prosper in your hands.
Happy birthday sir.
Ogbongeyan well done
Post a Comment