Pages

Wednesday 9 August 2017

NEWS: Charlyboy Faint After Police Officers Shoot Teargas give am.


Na the teargas wey police shoot Charlyboy make am faint for Abuja as him and some pipu go match for Abuja onto say make President Buhari Resume or Resign.

Popular musician, Charles Oputa, a.k.a Charly Boy just slump for ground as the teargas affect him system.
The daily sit-out dey organized by one coalition of Civil Society Organisations, CSOs, wey Charly Boy and Deji Adeyanju dey lead for the Millennium park, opposite the Unity Fountain, Maitama, Abuja, Nigeria.
The Police anti-riot squad change am for dem as dey begin shoot teargas and spray hot water to drive dem commot from the park and stop the sit-out protest wey dem dey do. Gist dey say the police dem still release dogs to pursue protesters.
One journalist wey dey cover the incident sef woundjor. Deji Adeyanju, tweet one video of the visit to the Silverbird Journalist and another pipu wey woundjor and dem don dey one clinic for the Federal Secretariat complex.
The protesters lament say Buhari dey set bad example as he don dey London for treatment for over 90 days now. Dey accuse him aides and associates dem say dey no dey gree yarn the truth about the real state of the president health as e be.

No comments: