Report dey say some gunmen just burst enter one St. Philips Catholic Church for Ozubulu, Anambra State as service been dey go on.
As The gunmen enter the Church, dem just begin spray pipu bullets, so far, na 11 pipu don pooff and 18 pipu don woundjor for the bloody Sunday attack.
The Governor of the State, Governor Obiano don land the church wey the attack for happen, he don go visit the victims dem for the Nnamdi Azikiwe University Teaching Hospital for Nnewi.
Governor Obiano yarn say: “This is sacrilegious, totally unacceptable in Anambra State. “We can’t allow this happen in Anambra, we must get everyone involved to face the music”
No comments:
Post a Comment