Pages

Thursday 17 August 2017

NEWS: Mob pooff soldier for Nassarawa.


No be small matta as some Mob vex gather and pooff one soldier wey he name na Lance Cpl. Ayuba Ali, for Akwanga, Nasarawa state.
According to reports, the gbege start as the soldier wey dey on mufti hit one street hawker as he dey ride him bike for Agwan Affi area of the town. All the beg wey the soldier beg no enter the mob dem ear as dey gather beat am until he enter coma, dey later rush am go hospital, na for there dey confirm say he don pooff.
As e be now, the state police command don launch investigation onto the matta. Dem don arrest Two pipu already in connection with the crime.

No comments: