Pages

Tuesday, 1 August 2017

NEWS: Police don arrest four 'Yahoo boys' onto the pooffing of popular Ghanaian IG user, DC Queen.


Reports been dey say dey see the dead bodi of inr popular Ghanaian social media user wey her name na DC Queen, her real name na Lydia Ama Serwaa.
Pipu see her bodi without her tongue and private party after she for groove for one party for Torch Pub inside Accra, Ghana.
As e be now, gist dey say the Ghana police for Dome-Kwabenya don arrest 4 boys onto the connection of the pooffing.
Police report say the 4 boys na yahoo boys and dem names na James Opoku, Yussif Ahmed, Akwasi Adae as well as Muhammed Abdul-Sadeek and dey don dey police custody for more investigation.
DC Queen gain popularity for social media as she like to dey post plenty foto of her as she dey party...
May her soul rest in peace.

No comments: