Pages

Monday 14 August 2017

SPORT: R.Madrid wipe Barca 3-1 as C. Ronaldo chop red card for the Spanish Super Cup first leg.


No be small matta for Camp Nou as R.Madrid show dem power, strength and experience as dem beat Barcelona for home 3-1.
The match hold ground gidigba as Pique open the net with own goal, Barcelona get penalty wey Messi convert to goal. Ronaldo score another goal, but the official ref say na offside, but dat one no stop Ronaldo to score again, dis time he commot him Jersey as he copy Messi Celebration for the Bernabue last season. With the celebration, he get yellow card, two minutes later, the ref give and the second yellow card plus Red card sake of say Ronaldo dive. The card pain Ronaldo sote he vex push the ref as he waka commot from field.
As e be now, R.Madrid dey on fire with and dey don get one advantage pass Barcelona for the Spanish Super Cup match. Dem go soon play the second leg.

No comments: