Pages

Sunday 5 January 2020

BADDOSKI DON BURN FIRE STATION AFTER FIR BURN MARKET FOR OYO STATE.

No be small gbeski for the ancient town of Akesan, Oyo State as one popular market catch fire for the early hours of Sunday.


Goods wey worth millions of naira don burn with the fire.
Akesan market na market wey pipu dey sell food stuffs, local artifacts, clothing materials, household utensils and so on.

As e be now, wetin cause the fire never dey confirmed, eyewitnesses arn say the fire ben start around 12:30am.
Some people yarn say e fit be say na electric spark cause the fire.

The Fire Station no too far from the market.
The people of the town vex wella as one official on duty yarn dem say dey no fit do anything to quench the fire because dem no get water for their fire truck.

The pipu dem vex burn down the truck and other property for the Fire station to protest.

As of the time of this report, fire fighters from Ibadan, the state capital,don show with backup from Ogbomoso quench the fire.

No comments: