Wednesday, 4 May 2016
GBOAA HAPPEN FOR ONITSHA MARKET, NA 12 PIPU WOUND
Na 12 pipu wound yaga-yaga anyhow as Gboaa blow for Kara market for Atani Road inside Onitsha, Anambra state.
DSP Ali Okechukwu wey be the Police Public Relations Officer (PPRO) for Anambra yonder yarn say the Gboaa wey happen so no be bomb O, he yarn say na petrol wey person keep inside keg blow con wound 12 pipu. The 12 pipu dey hospital now for treatment.
One Mr Sabo Mohammed wey be the leader of dat area say him use he koro-koro two eyes see as every happen. He yarn say na one boy wey nobody know just enter one canteen with 3kegs onto say he dey hungry and he wan chao. He say e no tay, the boy just leave the kegs dem commot without buying any food to chao, after some minutes na GBAOO dem hear wey con wound 12 pipu.
Now na 2 Akelebe moto don station for the front of the market and pipu don dey buy and sell as normal.
Stori : Vanguard.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment