Pages

Wednesday, 4 May 2016

REAL MADRID DON ENTER FINAL FOR UCL AS DEM WIPE MAN CITY 1-0 FOR SPAIN


Real Madrid don enter the final of UEFA CHAMPIONS LEAGUE as dem beat Man City 1-0 to qualify enter Final to go face Atletico Madrid for Milan on the 28 of May 2016.
The only goal wey Real Madrid score na from shot wey Gareth Bale play to score bit e con be deflection wey nack Man City Midfielder Fernadiho before the ball go score for around 20mins inside first half. The match been dey sluggish one-kind as some of Man City and Real Madrid players dey play like say dem don tire. C . Ronaldo play 90mins but na manage dem manage am to play, even Yaya Toure sef play with sign say him sef no too dey fit for the match.

The two teams play fire later for second half as Nigerian young star Kelechi Iheanecho enter for Man City to ginger dem spirit. C. Ronaldo try score some fine goals, but Hart wey be Man City goalie stand gigigba to make sure say another goal no enter him post again. Aguero wey be top man for Man City play one wicked shot to try equalize the game for Man City, but na small the ball take pass the the angle of the post. After 90 mins, na 1-0 Real Madrid take win Man City.


Real Madrid now go face Atletico Madrid for the final of the Champions League wey dey come up on D 28th of May 2016 for inside Milan. The two clubs been don meet for the 2014/15 final of Uefa Champions League, but na Real Madrid win the competition dat year.



Foto : goal.com

No comments: