Saturday, 28 May 2016
HALA MADRID!! R. MADRID BEAT A. MADRID FOR UCL FINAL AGAIN
No be small matta yesterday for Milano as R. Madrid meet A. Madrid for the final of the UEFA CHAMPIONS LEAGUE, A. Madrid fall to R. Madrid Again.
The final wey been get high expectations start like play like play. R. Madrid get upper hand for the first half as dem sharperly score dem first goal, na the captain of the side wey be Sergio Ramos open the net for R. Madrid to lead 1-0 against dem opponent.
The match no really get the spark as the hype wey surround am high pass the action for the field. For second half, Atletico Madrid con wake up as dem begin play R. Madrid until dem sef con get the equalizing goal to give dem hope as the game dey go
The two teams begin play seriously becos now dem dey 1-1 and time dey go. They drag the game enter extra time. After the first and second 15mins extra time, the score still dey 1-1, so dem enter penalty shoot out to decide the winner.
The players dem try wella, but no player really dey outstanding for the game until the penalty kick off. Na R. Madrid first take dem penalty kick, and dem score to give dem hope, A.Madrid sef score dem penalty until dem loose the fourth kick wey Juafran con play nack the side bar, after wey C. Ronaldo wey been dey quiet for the match con finally play the last penalty for Madrid wey make dem win the final of the 2015/2016 Champions League Trophy.
This one make am the 11th Champions League Trophy wey Madrid dey win. The first trophy wey Zidane dey win as coach and the third time wey C. Ronaldo dey win the Champions League.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)


No comments:
Post a Comment