Pages

Wednesday, 18 May 2016

MACHESTER UNITED BEAT BOURNEMOUTH 3-1 FOR OLD TRAFFORD


Man Utd host Bournemouth for inside Old Trafford as dem been postpone the game from Sunday becos of the bomb threat for Alex Ferguson Stand inside the stadium.


The game wey be the last match for the English Premier League season dull for first half as dem two dey struggle to score until Captain Wayne Rooney con shake the net with the first goal onside 43 mins before half time.


The  goal wey Rooney score so, make am 100   goals for Man Utd inside Old Trafford. Rashford score the second goal for Man Utd before Ashley Young con score the 3rd goal, but Chris Smalling do own goal to give Bournemouth consolation goal as the game con end 3-1.

Now Man Utd dey prepare for the FA cup final with Crystals Palace on Saturday.

No comments: