E get as e be O! Na 5 pipu head dey roll for ground as dem say na some jaguda pipu commot head from the body of dis pipu con throw am for road
The beheading happen yesterday May 1st for Edeoha inside Ahoada East Local Government for Rivers State yonder. The Matta set around 1am, Sunday morning. The target of the gbege na one babalawo wey he name na Uwuma Ichocho aka igwu and pipu say na him dey commot bullet for pipu bodi wey gun shoot. The pipu wey yarn for the Matta say na some cult boys dem the jaguda target as dem hear say D cult boys dey Igwu house dey hide, the jaguda pipu go Igwu house con commot head from the boys and babalawo head, con still throw am for road just like dat
No comments:
Post a Comment