Pages

Monday 2 May 2016

CHELSEA 2-2TOTTEHAM.. LEICESTER CITY DON WIN PREMIER LEAGUE FOR DIS SEASON



Na 2-2 draw dem play after the tough, hard and strong game wey Chelsea dey home against Tottenham. As we know the two clubs come from North London and dem get serious bad Belle for dem sef

Na so so yellow card dey fly like aeroplane for air as the match really hold ground like when two elephants dey fight. For 1st Half Tottenham dey lead with 2 goals, na Harry Kane score the second goal wey con make he goal reach 25  dis season. As second half start Chelsea greeda stand gigigba say lie-lie Tottenham no fit just come beat dem for the own Stamford Bridge, so dem play Tottenham wella till Cahill score D first goal for Chelsea inside second half. Long time beach warmer Eden Hazard enter for second half con score the equalizing goal for Chelsea inside die minutes.
As e be now, Leicester don automatically WIN the 2015/2016 English Premier League. Some Chelsea fans want make Leicester win the  league bcos of D bad Belle wey dey inside dem and Tottenham mind tay - tay. Even as D match dey go on for second half after Hazard goal, we begin hear Chelsea fans dey sing Leicester name as Champions for inside Stamford Bridge to show say dem no want make Tottenham win D League.
Ranieri na Chelsea before coach wey dem sack some time ago, now he don be League Winner.
Congrats to Leicester City.. Una do well..


Foto: goal.com

No comments: