Pages

Friday, 27 May 2016

NA TODAY BE JOSEPH YOBO HANGBOOTH MATCH WEY DEM CALL TESTIMONIAL MATCH


Every where for Port Harcourt Rivers State dey warm sake of the former captain of Super Eagles, Joseph Yobo hangbooth match.
Already, many starts don Land PH sake of the match. Starts like Jay-jay Okocha, Samuel Eto, the Ayew brothers dem dey expect David Moyes to land today too. Stars full ground to honour the Super Eagles skipper.

Meanwhile, na today Nigeria Super Eagles go play Mali onto friendly match wey dem arrange for France yonder. As e dey be, na Ogenyi Onazi go Captain the Super Eagles for France as Captain Mikel and vice Captain Ahmed Musa go dey PH to honour Joseph Yobo Today.

No comments: