Monday 2 May 2016
OSUN WORKERS YAB OGBENI AGREGBESOLA UNTO HALF SALARY
NLC for Osun State don Yab Gov. Aregbesola unto say na half salary he dey pay state workers since July 2015.
The chairman of NLC for Osun, Mr Yusuf Ganbi yarn journalist for the rally we dem take mark workers day on Sunday for yonder. Oga Ganbi say any time money scarce for naija, na state workers dey suffer am and D Matta be like monkey dey work baboon dey Chop. He yarn say the #56,000 wey NLC dey fight for so govt. fit pay am, so dat workers for naija go stop to suffer. He yarn say FG must dance to NLC reggae/blues so dat workers go begin enjoy and say make D salary no dey Delay again.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment