Pages

Tuesday, 10 May 2016

WESTHAM BEAT MAN UTD 3-2 TO SPOIL THEIR HOPE OF TOP FOUR DIS SEASON


No be small matta as Westham tie their wrapper well to battle Man Utd as be say na dem dey home.
Sakho open the net for 10 mins as the first half start, the match tough wella as D two teams play fire for fire game. Westham been get chance to make am 2 for first half, but Caroll miss one on one opportunity with Man Utd goalie De Gea, De Gea save the ball with him leg to maintain the score for 1-0 as first half finish.

Martial of Man Utd vex enter the field as he score the equalizing goal for Man Utd inside 51 mins of the second half. The game balance till the 72 mins wey Martial score the second goal again to make Man Utd lead 1-2 for second half of the tough match.

Westham no gree as e be say na dem dey home and dem been get more chances to score pass Man Utd, so for 76 mins Antonio equalize for Westham to make the game balance to 2-2. The two teams battle hard, but for 80 mins, Reid score the final goal wey make Westham win Man Utd to end the match.

As e be now, Man Utd wey been dey hope to end inside top four for Premier League table now go dey hope say dem still fit make am as Man City dey worry dem for the same spot too.

Foto:goal.com


No comments: