Pages

Wednesday, 22 June 2016

C. RONALDO DON TAKE VEX SPOIL ONE TV REPORTER EQUIPMENT.


One video don dey spread to show C. Ronaldo as he take vex spoil one TV presenter equipment as the reporter dey try interview am ahead of the match against Hungary.
So far, we dey hear say CR7 dey Para onto him team performance for inside the Euro 2016. The one wey pain Rinaldo pass na the penalty wey him loose against Austria. The coach say C.Ronaldo dey find am difficult to relax after him poor performance so far for the tournament so-te he No wan gree Chop and sleep well.

The video show Ronaldo as he collect the mic from the TV presenter with vex, con throway am inside one Lake to avoid the interview.

Portugal go meet Hungary today for match wey Portugal must win or dem go get fault for the tournament.






No comments: