Wednesday, 22 June 2016
THE KESHI FAMILY AND HIM LATE WIFE FAMILY DEY GBEGE ONTO WHERE TO BURY STEPHEN KESHI
The family of Keshi and Aburime Family wey be the late Big Boss wife family dey get small Gbege onto where to bury the late Stephen Keshi.
The wife family dey claim say make dem bury Stephen Keshi for Benin, where dem bury him wife wey he love so much, dem say dat one go make the two of dem happy.
But the family of Keshi don yarn say lie-lie, e no fit happen like dat becos the late Stephen Keshi na from Illah and na there dem go bury am put according to the traditional rites of Illah land. Dem explain say Keshi na important person for the land, and e go be tabu to bury such a man outside the land to avoid future traditional consequences.
The two families don gree now sha.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)

No comments:
Post a Comment