Pages

Wednesday, 22 June 2016

C. RONALDO GOALS AGAINST HUNGARY DON HELP PORTUGAL QUALIFY AS BEST LOOSERS


After many criticism, Real Madrid star, C. Ronaldo don finally prove him worth for inside the Euro 2016 wey dey happen for France yonder, as dem Play 3-3 with Hungary.



Na Hungary first score for the first half, before Nani help Portugal equalize the goal after 3mins, the first half end 1-1. Hungary vex come out for second half as dem nack another goal enter to lead Portugal 2-1. C.Ronaldo con open him scoring sheet as he help Portugal equalize to make am 2-2. Hungary vex score the third goal to lead again, but Ronaldo con still carry the Portugal team as he equalize the goal to end the game 3-3.

As e be now, Portugal don move enter the next stage as best loosers. Na fine evening for C.Ronaldo after Pipu don citize am say he never get any goal for inside the Euro 2016 tournament. Ronaldo wey been dey vex before the game don finally get himself back with 2 goals, and Portugal dey hope say C.Ronaldo go fit maintain dis scoring form for dem next match.






No comments: