Wednesday, 22 June 2016
LAWMAKERS NO GREE JOIN PRESIDENT BUHARI TO BREAK FASTING FOR ASO ROCK
E be like say the Senate lawmakers for naija dey vex with President Muhammadu Buhari as dem no gree honour him invitation to join am break fast as dem dey do together before.
News dey say the lawmakers no gree show for the break fast sake of the pressure wey dey dem head as both Saraki and Ekweremadu dey face new allegations with EFCC and dem no happy with the matta. Saraki yarn say him don tire as he No fit dey try answer CCT trial make EFCC con still bring dem own.
Meanwhile, some yarnings dey say the lawmakers dem dey vex as dem no understand why pressure con touch for dem head like dis. The PDP lawmakers been don already reject the offer to follow break fast with the president, becos dem feel say the FG dey target dem PDP pipu wella sake of corruption matta.
But as e be, gist later fly say na the president cancel the break fasting with the lawmakers dem.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)

No comments:
Post a Comment