Pages

Sunday, 26 June 2016

CHILE BEAT ARGENTINA TO WIN COPA AMERICA


Chile beat Argentina after dem Play full time, extra time and penalty to win the 2016 Copa America Centenario tournament wey dey happen for America. Messi miss penalty for  the game.
The match sef been get as e be, to me O, the match boring. Na 2 player collect red card for first half, one chile player and one Argentina player. Messi sef collect yellow card for diving inside the fish half. Gonzalo Huguain miss one very good open chance to make Argentina lead for the first half.

The second half start with 0-0 draw score line, as the two teams begin battle for goal, but the goal no show. Na after 120mins without goals dem con play penalty to decide who go win the competition.

Messi miss penalty for Argentina, the penalty end 4-2 to favor Chile as dem win Argentina again for the second final of the Copa America to win the trophy as back to back champions.

Bravo wey be Chile captain and goal keeper win the Golden glove award as the best goal keeper for the tournament, Alexis Sanchez of Arsenal sef win the best player of the tournament award.



No comments: