Pages

Tuesday 14 June 2016

EFCC DON RAID THE OBANIKORO'S DEM HOUSE FOR IKOYI


The operation of the EFCC don storm the Lagos house of former minister of state Defence, senator Musiliu Obanikoro as dem carry some him cars plus other things go.
The 2 houses wey EFCC raid so, one na the private residence for Parkview estate wey Obanikoro dey stay, the other na for near Banana Island where the 2 sons Jide and Gbolahun Obanikoro dey stay with dem family for inside Lagos.

Jonathan Eze wey be the media aide to the Obanikoro's say EFCC come raid the house as dem carry some cars and gold wrist watches with some other valuables commot from the house, he say as the Obanikoro's no dey around, the EFCC operative intimidate the pipu wey dem meet for the house.

He still yarn say na only children with women dey the house when EFCC show, na so dem begin oppress and intimidate the children and women dem without any good reason. He yarn say he wonder why dis kind thing dey happen now as EFCC never invite any of the Obanikoro's to appear onto any money related issues as dem no dey under EFCC investigation.




No comments: