Pages

Tuesday 14 June 2016

LATE COACH AMODU POOFF AS A POOR MAN - - FAMILY DON YARN.


The family of the late four times former coach and tech director of NFF Amodu Shuaibu pooff as a poor man as NFF dey owe am some salaries.
The former Super Eagles Coach pooff on saturday June 12, 2016 after he complain of chest pain before he sleep no wake, and dem don bury am according to Muslim rights.

But the family don say NFF dey owe the late coach 7 months salary and na #800,000 be him salary before he pooff. Dem say the money wey Amodu dey see no dey reach to take care of the family members plus him 8 children dem. The family  say na every time Amodu dey pressurize the NFF onto the payment of him salary before he pooff.

The General Secretary of NFF, Mohammed Sanusi don confirm say na true say dem dey owe the late coach, but no be 7 months dem dey owe am as the family the claim, say na just 2 months salary dem owe am before he pooff and dem go pay am to the family sharperly.

*Just 2 months salary?.. Just? *








No comments: