Pages

Friday 17 June 2016

EKITI DOCTORS DON START INDEFINITE STRIKE.UNTO NO SALARY AND POOR FACILITIES


The medical doctors of Ekiti state don yarn say dem don start indefinite strike as the State Government no gree pay dem salaries and poor working facilities.

Na the president of the Association of Resident Doctors, Tunji Alaoye and Folu Ekundare wey be the Chairman of the National Association of Government General Medical and Dental Practitioners for Ekiti State sign the statement to confirm dem strike action..

See dem statement.

*e be like say na to talk and tackle President Buhari plus to dey chop Ewa Agoyi Beans with Bread oga Fayose Sabi.. Make he look into the state issue o*




No comments: