Pages

Friday 17 June 2016

ASHAWO DEY OFFER FREE STRAFF SERVICES FOR SOUTH AFRICA TO CELEBRATE YOUTH DAY.


Ashawo no dey go on strike. The Ashawo dem for South Africa don yarn say na free services dem go offer to celebrate Youth Day.
The National Association of Mavuso NAM yarn dis yearnings for South Africa say dem ready to offer free service give customers to celebrate Youth day and dem aim na for the government to pay more attention to the Youths of the country.

Dem say after dem action, dey hope say the SA government go take the needs of the Youths serious and look into the welfare of many Youths for the country. Dem say na becos of the way government ignore many Youth make some of dem join the Ashawo business so.

One Ashawo say since dem annouce the free straff program  na two men don con patronize her for free and she still ready for anybody wey go like sample her product, she con end am say she happy to fit help the society in her own way.

*help? How? *




No comments: