Friday, 3 June 2016
GOODNEWS!! FG DON SCRAP POST UTME
The Federal Government don scrap the Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME). For pipu wey dey find admission enter school after dem pass JAMB.
Na the Minister of Education Mallam Adamu Adamu yarn dis yearnings on Thursday as he declare open the 2016 combined policy meeting on admission for Universities, Polytechnic and other institutions for inside Abuja wey the meeting for hold.
He yarn say FG believe in JAMB, so no need to dey do another exam. Mallam Adamu yarn say make JAMB stop to dey change other money for matta wey concern change of institutions or change of course and other mattas.
JAMB now don say na 180 go be the cut off mark for the next exam wey dem go conduct and the 180 cut off mark go affect all schools inside Naija
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment