Pages

Wednesday 8 June 2016

GOV. EL-RUFAI DON GO SEE THE CARPENTER WEY MUSLIM YOUTH ATTACK BECOS HE DEY EAT AS DEM DEY FAST.


No be small matta on Tuesday for Kakuri, Kaduna South Local Government, where one 41 years old carpenter almost pooff for the hand of some Muslim youths onto say he dey Chop as dem dey fast.


The carpenter name na Mr Francis Emmanuel Francis and him dey hospital now after dem gather am like fly wey see shit, con wound am anyhow, almost spoil him eye sef.

The state Governor don go see am for the hospital wey dem rush am go, as he condemn the attack on Mr Emmanuel Francis the carpenter. The victim say him just Dey eat him own jeje, some young boys come ask am if him dey fast, he say no, before he fit talk another thing, dem don wouse am hot slap con begin beat-beat am.

Make una Read wetin he yarn...


No comments: