Pages

Wednesday 8 June 2016

ONE PDP GROUP DON ADVICE GOV FAYOSE MAKE HIM STOP TO DEY TALK ABOUT FG AND RESOLVE HIM STATE PROBLEMS.


One group inside PDP wey dem call 'Concerned Stakeholders' don advice Ekiti State Governor, Ayodele Fayose say make him stop to dey critize the Buhari Government, make him find solutions to Ekiti State problems.


Na Prof, Tayo Akinyemi sign the statement on behalf of the 'Concerned Stakeholders'  inside PDP. The group say instead wey Fayose go dey find solutions to the problems dem wey dey him state, na to dey critize FG be him focus. Dem say make Fayose find how he go take pay the state workers salaries.

Meanwhile, the state workers been say dem no want the Governor to join dem for any strike, instead make he find as he go take pay dem salaries. Dem say some of the staffs dem for like resume, but no money for transport to move from house to office.

Dem say dey understand say Fayose dey try feel among, but no be dat one dem one Chop.


No comments: