Pages

Saturday 4 June 2016

GOVERNOR AMBODE DON YARN SAY NOBODI TRY KIDNAP HIM MAMA.


Rumors been fly ontop many news papers and blogs say some pipu wan try kidnap the Governor mama, Mrs christiana Ambode for her creep.
Governor Ambode don yarn say nobody dey try kidnap him mama. Na Mr Habib Aruna yarn the yearnings for one press statement as na him be the Chief press secretary, he say wetin happen for the front of the Governor mama house no be kidnap attempt O.

He con still yarn say na true say some Gbege happen for the house wey dey Gbagada area but no be as newspaper and press pipu take carry am. He say na one man Park for front of the creep, so the police dem wey dey secure the creep con tell am make him no Park for there bit him no gree.

He say the man con dey claim say him na military personnel, but the police dem say make him no Park for the front of the house, yet he Park there, con commot go call military men dem wey dey with the Operation MESA to come Beat the police dem. We hear say the military men beat the police dem wella.

Mr Habib say the state government go make sure say dem gbab the man wey say him na military personnel and say make press pipu plus newspapers dey watch wetin dem dey publish becos the tori say na kidnap, but nothing like that.

No comments: