Pages

Saturday 4 June 2016

GOVERNOR FAYOSE SAY HIM DEY ON STRIKE IN SOLIDARITY WITH HIM WORKERS DEM


Ekiti State Governor, Ayodele Fayose say him don dey on strike too as many of the state workers sef dey on strike and nothing him fit do.


Fayose yarn dis yearnings ontop televised broadcast for Ado-Ekiti, he say him don dey indefinite strike as nothing him fit do about the non payment of salaries matta for the state.

He say he join the strike becos him dey feel the pains of the state workers as money no dey to pay staffs. He say for him first term, 2003-2006, him dey pay workers
salaries on the 21st of every month, but as e be now, everything don change and nothing him fit do dan to follow join the strike.

He say him dey expect the worker to resume back to office anytime dem want, but make dem try put the interest of the state for dem mind.

No comments: