Pages

Saturday 4 June 2016

KANO STATE GOVERNOR DON MEET THE HUSBAND OF THE WOMAN WEY MOB POOFF FOR KANO MARKET SAKE OF BLASPHEMY



Kano state Governor, Umar Ganduje don Meet with the husband of the woman wey pipu pooff for inside market for Kano state. 


The man name na Pastor Mike Aghahime, and the woman wey pooff so na, Mrs Bridget Patience, dem be Ibo and christains wey dey attention the Deeper Life Church.

The Governor meet the husband Mr Mike with the president of the Christian Association of Nigeria, Kano chapter and the leader if the Ibo's of kano. The Governor condemn the attack and console the the woman husband

He say the poffing of the woman dey illegal, unjustifiable and she been no get fault for the matta.

Meanwhile we dey hear say Police dem don gbab 2 pipu wey connect with the poffing matta. Dem confirm say dem don get one Alhaji Dauda wey be say na him cause the argument wey make the woman loose her life. Dem say the other suspect wey dem gbab dey among pipu wey poof mrs Bridget Patience, and dem don dey investigate the matta seriously.

No comments: