Pages

Monday, 27 June 2016

IBRAHIMOVIC GO ENTER MAN UTD FOR MEDICAL DIS WEEK.


Na sky sports dey yarn dis report as e dey hot. Dem yarn say Ibrahimovic don set to enter Man Utd dis week for him medical.
The striker wey just retire from National football been don dey yarn abt working again with Jose Mourinho wey be the new Man Utd boss. He say dem dey always keep in touch and Jose Mourinho na him very good padi since dem work together for Inter Millan.

We dey hear say Liverpool sef dey table £30 million for Southampton midfielder, Mane. Klopp dey try arrange him side before the new season go start and na Mane go be the second player wey Liverpool go sign after dem sign one goal keeper enter dem club.



No comments: