Pages

Wednesday, 22 June 2016

MESSI DON BREAK RECORD AS ARGENTINA BEAT USA 4-0 INSIDE COPA AMERICA.


Barcelona and Argentina star, Leo Messi don break record as the highest goal scorer for the Argentina national team as he score one free kick to make him national goal enter 55.

Na Gabriel Batistuta been get 54 goal for the Argentina national team as the highest goal scorer before Messi free kick against USA break the record as Messi don get 55 goal for him national team.

Before the second half start, one Messi fan rush enter the field go bow for Messi as the greatest player him don ever meet,  Messi appreciate the guy as he just Dey smile.

Argentina and USA play the semi final match for the Copa America Centenario tournament wey USA dey host, but USA loose to Argentina. Na 4-0 in favor of Argentina the match end.

Now na either Colombia or Chile go meet Argentina for inside the final of the Copa America Centenario tournament. If na Chile and Argentina meet, e go be revenge for Argentina as Chile been beat dem for the final of the last Copa America tournament, but until den. ..





No comments: