Pages

Tuesday 7 June 2016

NA 2 SECONDARY SCHOOL STUDENTS DEY HOSPITAL AFTER DEM PROTEST YESTERDAY FOR OYO STATE ONTO PRIVATIZATION OF PUBLIC SCHOOL.


No be small matta for Oyo State yes as plenty students enter Street to protest against Privatilization of dem public schools, NLC for Oyo join the protest too.
The students with NLC dem Gbege enter streets as dem begin spoil tins as dem dey protest against the Privatilization of public school. We hear say dem the students go the APC Secretariat wey dey the state to destroy tins.

Agbero sef use the opportunity enter the strike to obtain pipu and shops as the Gbege dey happen.

Na 2 secondary students dem wound for the protest, but dem don carry dem go the University College Hospital UCH. The students dem don dey recieve treatment and dem don dey stable as for now.


The state government do  yarn say dem no dey privatize any school for inside Oyo State, dem just wan open the educational sector for private bodies to join hand, so dat the schools inside the state go dey kankpe.

How una see am??

No comments: