Pages

Wednesday, 1 June 2016

NA BOKO HARAM MAKE TOMATOS COST FOR NAIJA - - OGA LAI MOHAMMED


Oga Lai Mohammed wey be the minister of information and culture don yarn say na Boko Haram dem cause tomato to cost now for Naija.
Na ontop Channels Television Oga Lai yarn say many farmers don run commot for North-East bcos of Boko Haram wahala for yonder. He say many Okada pipu for Lagos suppose dey farm to produce consumables items, but as Boko Haram don too threaten dem, dem run commot come Lagos dey ride Okada to survive.

He con ask say 'Do you farm where there is war?' he say 'we lost 2 seasons of harvest becos of Boko Haram wahala plus say rain no too fall last year and dis year,. Na the combination of this problem dem make tomatos cost, make una go ask agriculturist and economist wetin I just yarn, dem go clear U.'  

No comments: