Pages

Saturday 18 June 2016

NEYMAR AGENT SAY BIG DEAL DEY DOWN NOW FOR THE BARCELONA STAR. sah


Wagner Ribeiro wey be the agent of Brazil and Barcelona star don yarn say na 3 big clubs wan sign Neymar with heavy money.
The agent say some clubs wan drop £157 million for Neymar to join dem club next season, he say the £157M go reach to buy out the release clause from Barcelona.

Na ontop one Brazil radio station, Joven Par, he for yarn dis yearnings, he say he No fit mention the names of the clubs dem wey wan sign Neymar yet becos the deal dey hot.

The Sun been report say clubs like Man Utd, Man City and PSG dey find the signature of the Barcelona star before the season go start.

*abeg who go sign me*

No comments: