Wednesday, 22 June 2016
SEE THE LETTER OF RESTRICTION WEY ZENITH BANK ISSUE GOVERNOR FAYOSE.
Na the letter of restrictions wey Zenith Bank Issue give Governor Ayodele Fayose, so dat he No fit withdraw money from him account.
The Letter dey come after EFCC direct Zenith bank to restrict Governor Ayodele Fayose from him personal accounts with dem.
The matta don dey trend everywhere as Fayose dey Para say why dem go freeze him account.
The matta even reach level wey be say Governor Fayose and the first lady of Nigeria, Aisha Buhari exchange words for social media.
We dey hear say some money from the Dasuki Gate sef dey inside Governor Ayodele Fayose account and EFCC wan begin investigate am
Subscribe to:
Post Comments (Atom)

No comments:
Post a Comment