Pages

Wednesday, 22 June 2016

WOMAN SLICE HER NIECE NECK WITH RAZOR BLADE FOR BAIYEKU, IKORODU. NA 4 YEARS SHE GO SERVE FOR JAIL.


Na 4 years wan woman wey her name na Funmi Otitoloju go serve for jail after she slice her niece wey her name be Adeola Otitoloju for neck with Razor, inside Baiyeku area of Ikorodu.
The aunty Funmi claim say on Thursday, June 9, 2016 her niece Adeola wey na 12 years old enter her house come steal something. Her neighbors say she don dey find way to punish the girl since but as pipu dey shuk mouth for the matta as dem dey ask her wetin she steal, but Funmi no fit talk anything.

She later catch her niece con take blade slice her neck to punish her. Na The neighbors sharperly carry the girl go hospital, but for the hospital, dem no gree treat her until dey see police report. So dem carry the girl go Child Protection Network CPN for Ikorodu before dem con involve Akelebe and treat the girl.

The aunty Funmi been dey Akelebe hand, and dem don transfer her case go the Ikorodu magistrate court, na there dem dash her 4 years of service for jail.









No comments: