Pages

Friday 17 June 2016

SENATE DON PASS THE BILL FOR GOVT TO DEY BUY MADE-IN-NIGERIA PRODUCTS.


The Senate don yarn say government agents must dey buy made-in-Nigeria products as e be for the passage of Public Procurement Act 2007 (amendment) bill 2016.
Dem say the bill dey say government officials must dey patronize Made in Nigeria products wey dem make locally for inside Naija.

After dem don consider and pass the bill, Senate President, Bukola Saraki yarn say government must look into local products as e go help boost our economy now wey things dey shake onekind.

He yarn say dis kind thing don help many countries wey dem sef been get economic crisis. He con say the FG don ready shorten the process to dey award contracts so dat contractors go fit dey quick finish dem projects and e go easy dem to monitor.

Senator Bukola Saraki con finally thank him colleagues dem as dem pass the bill to patronize made in Nigeria products.

*why dem no pass the bill before dem go dey buy new SUV's? *






No comments: