Wednesday, 22 June 2016
SWEDISH PLAYER COLLECT RED CARD, COS HE MESS ONTOP FIELD AS MATCH DEY ON.
Na mess make Adam Lindin Ljunskrist collect red card for the last match wey Sweden play inside the Euro 2016.
The Swedish Football Association don yarn say dem never see or hear dis kind tin before say player collect red card becos he mess ontop field. Adam Lindin been don collect one yellow card before, but the mess wey he mess ontop field con make the referee give am the second yellow before Red card con escort am.
Although Sweden don ja from the competition, the controversial Red card don dey trend as many pipu dey wonder if to mess now na crime.
The referee say he give the Swedish player red card becos he intentionally mess the mess to disrespect him as a referee becos na for him front he for mess the mess and the mess Loud wella so-te, e con be like say he mess the mess to annoy dem opponents and disrespect the referee.
The referee say dat kind mess fit provoke the opponents dem and na disrespect for him as the guy intentionally mess the mess to cause kata-kata, some players sef say the mess loud wella as dem sef hear the heavy sound.
*Na wa O.. Maybe FIFA need to make messing break for inside match, and make dem fit messing toilet becos i feel say mess na fee gift of nature, why hold am when U fit release am? Lol.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment