Pages

Wednesday, 22 June 2016

ZENITH BANK DON DENY GOVERNOR FAYOSE TO AVIOD POLITICAL PORTO-PORTO


The management of Zenith Bank do openly deny Governor Ayodele Fayose as he claim say na the bank give am money to run him electoral campaign for Ekiti State.
The matta dey show face after Governor Fayose begin get case with EFCC, as EFCC DON direct Zenith bank say make dem No allow Governor Fayose access to him account because of investigation of some money wey dem claim day Fayose collect from 'Dasuki Gate' to run him election parol.

Fayose been dey claim say na Zenith bank loan am the money wey him take run him elections, but as e be now, Zenith bank don dey say dem no get hand inside wetin Governor Fayose dey claim so, as dem no fiance anything like dat, dem say make Governor Fayose publish him bank statements for all him 3 accounts wey him get with Zenith Bank, so dat the public go see am and understand wetin dey happen.

Zenith bank say dem no dey dis kind yama-yama wey Governor Fayose wan take rub dem and make Fayose no drag the bank name enter any political porto-porto.







No comments: