Pages

Sunday 12 June 2016

UEFA DON WARN ENGLAND FA & RUSSIAN FOOTBALL UNION AFTER DEM FANS GBEGE


UEFA don vex for both England and Russian FA's after dem fans Gbege after dem game wey end 1-1 draw for the UEFA European competition wey dey happen for France.
The waring dey strong for UEFA mouth as dem say if the England FA and the Russian Football Union no fit talk to dem fans make dem behave, dem go totally ban dem for the competition.

UEFA say dem go impose sanctions and heavy fines ontop the two countries if dem fans cause any Gbege again as the competition dey go. Dem yarn say dem totally condemn the attack as e no make sense and any country wey try any gbege again go automatically commot for the tournament.


No comments: