Thursday, 23 June 2016
VARDY DON BORNE ARSENAL £150,000 PER WEEK DEAL
England and Leicester City player, Jamie Vardy don borne the £150,000 per week deal wey dem offer am as he don sign new 4years contract with Leicester, and na £100,000 per week dey the contract.
After the victory for the season wey just finish so, Jamie turn hot cake for market as some clubs, including Arsenal wan sign am.
Upon say Arsenal ready buy Vardy release clause of £20 million, Vardy just extend him contract with Leicester to keep am for 4 more years with £100,000 against the £150,000 wey Arsenal ready to pay am per week.
Arsenal now don shift dem antenna go Alvaro Morata side as dem ready get the striker from Juventus, but we dey hear say R. Madrid sef dey interested to carry Morata with £40million.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment