Pages

Friday, 1 July 2016

#90,000 IF U BUY OR HAWK FOR LASGIDI-- GOV AMBODE DON YARN ONTOP TVC.



The Lagos State Governor, Akinwunmi Ambode don yarn on air for (TV-C) to announce say the laws on Street Trading for Lagos State go dey strictly enforced from July 1, 2016..


Both Seller and Buyer go dey guilty and the penalty fine na #90,000 or 6 months imprisonment or both together . dat is, the fine plus the imprisonment . . He con yarn say make pipu note and abstain from buying from Street Hawkers.

I believe say dis matta dey happen like dis now after the incident wey involve one street hawker wey poof when one trailer jam am as KAI officials dey pursue am. After the accident, the other hawkers con begin vex becos all the KAI officials  wey cause the matta don run, as a result, dem begin spoil the Lagos State BRT buses.

Dem the BRT buses wey dem destroy so really touch the BRT operators and the Lagos State Government, becos no be BRT poof the hawker. Now, if u buy or sell na #90,000 or imprisonment or the two join.

*Chai.. Wetin go happen to gala and lacasera now? I go miss dat trips sha*




No comments: