Pages

Sunday, 2 July 2017

NEWS: Two 300L FUTA students drown as dem dey try to take selfies ontop canoe.


Two students of the Federal University of Technology Akure (FUTA) Ondo state, pooff on Saturday as dem dey try take selfies ontop canoe inside river for the town.
The two students dem dey their 300 level, dem dey the boat as part of activities for one entrepreneurial course dey enrol for dis semester.
One of the boys na student of the department of Agriculture and Environmental Engineering as the second one na student of the department of Project Management Technology.
According to their colleagues, the boys join their colleagues for the boat and dem dey take selfies when suddenly the boat capsize.
Dem don commot the bodi dem from river, Two other students wey know how to swim survive the incident. The bodi of the student dem wey pooff don dey mortuary now.

No comments: